JUST IN: Beatrice Ekweremadu return to Nigeria afta jail term for UK

Nigerian politician Ike Ekweremadu and wife Beatrice. Na celebration galore for Nigeria politician Ike Ekweremadu village as tori of im wife return from UK prison dey give im supporters joy. Local media share video of market women wey dey celebrate for Enugu Southeast Nigeria for social media. “Na three months ago madam Beatrice return to Nigeria,” one family member tell BBC. Di relative wey no want make we tok im name say na on Wednesday di wife of di Nigerian politician enta di kontri....Read Full Article >>➤

Details of her release neva clear but for May 2023, di UK court bin sama Beatrice wit jail sentence afta court find am guilty inside case of organ trafficking. Dem convict Senator Ike Ekweremadu, 60, im wife Beatrice, 56, and Dr Obinna Obeta, 50, say dem conspire to exploit di man for im kidney, in di first of such case under modern slavery laws.

Ike Ekweremadu, wey di judge describe as di “driving force throughout”, dey sentenced to nine years and eight months in prison.

Dr Obeta dey sentenced to 10 years afta di judge find out say e target di potential donor wey dey young, poor and vulnerable.

Beatrice Ekweremadu dey sentenced for four years and six months due to say dem say involvement dey more limited.

Beatrice and her husband, former Nigeria Deputy Senate President Ike Ekweremadu land prison afta UK police arrest dem two along wit dia doctor, Obinna Obeta, for plotting to arrange illegal organ transplant for March 2023.

See also  SHOCKING: Celestial Prophet Shut Down Inside Church In Ogun

Di 58 years old bin chop accuse for conspiring wit odas to bring one street trader from Nigeria come London to use am as kidney donor for her daughter.

Dia daughter Sonia Ekweremadu bin no well and bin require kidney transplant.

Background of di tori

Di Ekweremadus enta gbege as dia make become di first ever case afta di UK sentence dem.

According to UK authorities di convicts bin carry di victim wey be street trader from Lagos go UK for 2022 wit offer of up to £7,000 and promise of opportunities for UK.

Di victim bin suppose provide im kidney for inside one £80,000 private transplant wey for occur for di Royal Free Hospital for London.

Di goment say na only wen di victim meet doctors for di hospital, im realise wetin dey go on.

Dem allege say di defendants bin try convince medical personnel for di Royal Free to follow dem pretend say di victim na Sonia cousin, wey no well and dey collect dialysis every week, even though dem no relate.

Di victim wey bin dey 21 years at di time say, im desire to work or study for UK na im make am agree to medical tests for Lagos plus meetings wit doctors inside London, as e believe say e dey required for im UK visa during di Covid pandemic.

E say im only realise wetin dem dey plan wen e meet doctors for di Royal Free Hospital for London wey begin dey discuss about kidney transplant.

E tell di court say, if to say im know, e for no agree to am, as e add say: “My body no be for sale.”

See also  UPDATE: Amotekun Set To Recruit 1,000 Personnel In Osun State

Inside one statement wey di victim bin give for 2023, im say e “no fit tink about going home to Nigeria”, as “dis pipo dey extremely powerful and I dey worry for my safety”.

E no clear now wia im dey or wetn dey happun to am at dis time.

Wen di incident bin happun, im refuse to apply for financial compensation from di Ekweremadu family, as e tell one detective say e “no need or want anytin from di bad pipo” ...Read Full Article >>➤

Be the first to comment

Leave a Reply